Resident Doctors don suspend strike

Di National Association of Resident Doctors don announce say di strike wey dem bin start, dem don suspend am. Dis suspension go start for on Monday, 22nd June, 2020.


Di organisation dem reason di mata so unto say dem wan give government time to do wetin dem suppose do as den don receive beggings from Speaker of the House of Representatives, Femi Gbajabiamila, Secretary to di government, Boss Mustapha, Chairman for Nigeria Governors' forum and oda pipo wey bi stakeholders untop di mata.

NARD tok dis mata for one communique wey dia president, Dr. Aliyu Sokomba read to journalists on Sunday for insde Abuja after dia National Executive Council meeting wey pipo wey attend reach like 300 of dia members.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.