PDP don extend di selling of dia forms for Ondo state make Agboola for fit buy

Di Peoples Democratic Party (PDP) don extend di deadline of di selling of Expression of Interest and Nomination forms, (di form wey persin wey get mind to contest for election dey buy) for Ondo state Governorship election. Di deadline wey di party bin announce na June 22, 2020 but as dem don extend am, pipo wey wan buy still fit still buy til June 24, 2020.




PDP yarn dis mata on Monday night from mouth of dia National Publicity Secretary, Kola Ologbodiyan. Dem no give any reason as to why dem change the time but one party official give coded gist for di state thru telephone say di extension na to allow di Deputy Governor of Ondo state, Agboola Ajayi wey port from APC to PDP to collect im own form. Ajayi wey port enta PDP on Sunday unto kasala wey burst between im and im oga, Governor Rotimi Akeredolu unto say im set wan contest for Governor of di state for di election wey go happen for October 10, 2020.


.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.