Pastor Charles Osazuwa say na sin to dey rented house as tenant
Charles Osazuwa, wey bi founder of Rock of Ages Christian Assembly Inc, don yarn say, na sin to dey live for inside rented apartment.
Na for di message wey im preach on im Faceook wall on Thursday im yarn di mata.
Di pastor say na sin to rent house as Christian unto say di Christians go com get two lord - Jesus and di landlord.
Say di tenant go always de under di landlord. Di landlord fit call di tenant anytime, Im fit even say Im wan use Im house anytime wey Im like. Any Christian wey bi tenant suppose dey hustle make im for free for di hand of di second lord wey be - landlord.
Osasuwa still say church dem wey dey operate for place wey dem rent dey inside dis gist wey im dey gist so. Say church wey rent place don get two lord. E nor suppose bi so.
I want to know how many houses has he built for his family members?? let alone his congregation??
ReplyDelete