Oby Ezekwesili lose her mama to Cancer.
Dr Obiageli Ezekwesili wey bin run for president and also bi education minister dat year don loss her mama, Mrs Cecilia Nwayiaka Ujubuonu.
Persin wey dey speak for Ezekwesili, Ozioma Ubabukoh, yarn for di statement say Mrs Ujubuonu die for on Sunday night, June 21, 2020 and she bi 78 years wen she die.
She come from Ndodolu village Umunuko, Ukpor for Nnewi south Local government area of Anambra state, she bin loss her husband, Benjamin Ujubuonu for 1998.
Dem born her for April 18, 1942, Ujubuonu wey bi retired businesswoman devote her life to her pikin and grand children dem, plus join her church and to dey helep pipo.
She die for her pikin arm, Oby Ezekwesili, on sunday for Abuja unto cancer mata.
Before she die, na Redeemed Christian Church of God she bin dey go.

Comments
Post a Comment