Nigeria fit enta recession dis year
As di deficit financing of di 2020 budget of N10.509 trillion wey dem revise from N1.847 trillion go reach N4.563 trillion, di economy fit dey go recession as di minister of Finance, budget and National planning don dey loud am so.
She show fear yesterday for Abuja for one session wit di Senate Committee for Finance wia di oga dem for revenue-generating agencies don make presentation for di revised 2020-2022 Medium Term Expenditure Framework (MTEF) and di Fiscal Strategy Paper (FSP).
Di minister don tok say di revenue wey dem dey expect from di agencies don go down well well.
As she tok, 77 percent of di money wey dem dey expect na from places like di Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC), the Federal Inland Revenue Service (FIRS) and di Nigerian Customs Service (NCS) go go for debt servicing.
As she dey answer question on mata wey fit happen if economy enter recession, Ahmed tok say 'E clear say di Gross Domestic Product (GDP) don reduce because of di wahala wey dey ground now but nor b only Naija dey face am.
"All di country wey dey dis world fit enter recession. We dey believe say we go do our own - the executive and the National Assembly - go try reduce how e go affect di country.

She still yarn am say, The National Bureau of Statistics (NBS) say we go enta recession reach four percent.
"Di work wey di executive dey do now na to try reduce as di mata go affect we pipo"
"Dis mata no sweet belle but na so we see am"
Una remember say di money wey dem dey expect from Nigeria Customs Service hand don reduce from N1.5trillion go reach N950 billion, FIRS' stamp duty money sef reduce from N463 billion to N200 billion, as di N1.222 trillion wey dem wan use for NNPC federal project reduce to N484 billion.
Comments
Post a Comment