Na Mbappe get money for head pass for transfer market
One website wey dey rank players for transfer,
transfermarkt, don update dem list with top 50 players wey shaprapra pass for transfer market.
transfermarkt, don update dem list with top 50 players wey shaprapra pass for transfer market.
For di list so, na Mbappe dey number 1 as player wey get money for head pass.
Sterling and Neymar play draw for dis mata as two of dem get €128m, Kane, Salah, Mane and Kelvin De Bruyne follow join like that. Messi dey number 9 as Alexander-Arnold dey im back wey make Alexander-Arnold bi di only defense for top 10.
Sancho wey dey shine for Bundesliga, Harvetz, Haaland and Gnarby dem dey inside top join wit Serie
A stars Dybala, Lukaku plus Eriksen
Ronaldo wey bi 35 years dey number 46 as di money wey dem put for him head na €60m as Dembele own bi €56m
.





Comments
Post a Comment