NA LIVERPOOL BE CHAMPIONS OF ENGLAND FOR 2019/2020 SEASON




As Manchester City lose dia game against Chelsea, e con mean say Liverpool now don become champion for di fa 30years. Di reds bin don try did season as na only against Manchester United, Watford and Everton dem drop points for di 31 games wey dem don play so far. As coronavirus show, e con bi like say dem go cancel di season before but thank God say e nor happen and Liverpool don finally bi Champion. E mean say Liverpool don win di 19th league title after dem don dey wait for 30 years. Di last time wey dem collect di league na for 1990.

As e dey hot for dia bodi, di club na dem quick collect am pass for history of premier league, as dem still get 7 games to play.

D reds don set new record of win for home wey many pass wit dia win against Palace, wey bi dia 23rd win for one row.



Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.