WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM
ANAMBRA STATE POLICE COMMAND DIARY: *SUDDEN DEATH* Today wey bi 5/07/2020, one report enta from Aguata Police Station as one Bernard Ezeuboaja of Umuchuana village inside Ekwulobia for Anambra State yarn say on dat day, im find out say im wife, Obiagele Eeuboaja wey bi 65 years and her house boy, Chikamso wey bi 12 years nor gree wake up from sleep wey dem sleep for night. Na as im open door im meet dia dead bodi. For Police report, Police pipo wey dey Aguata division visit di place wey di mata for happen and dem rush di victims go hospital for treatment but doctor say dem don die before dem carry dem enta di hospital. Investigate show say di dead pipo bin dey burn charcoal for di room as dem close all di windows becos of cold and breeze nor see space enta. Di container wey dem put di charcoal don dey wit police now as exibit and dia dead bodi don dey Ekwulobia hospital mortuary to take find out wetin really kill dem. Di investigate still dey go. *SP Haruna Muhamme...



Comments
Post a Comment