Lesbian wey kill partner sake of say di partner catch am say she sleep wit man





One woman don die after her lesbian partner stab her till she die and she leave di body make e rotten for many days.



Di woman wey die, wet her name bi Vivian, catch her lesbo partner Spicykvng Vee say she dey nak man.




Spicykvng Vee, wey everybodi don know as comfam lesbo, feel shame as Vivian catch am with man. As she dey worry about her levels for area, Spicykvng con beg Vivian make she nor vex and Vivian sef con gree say she nor vex again.

But as di mata bi, she still dey fear say Vivian fit still leak mouth on top Facebook, so she con stab her till she die for Delta state and she tear race go Enugu state after she con call Vivian mama, tell am say Vivian don travel.

Na after three days wey her friends come dey worry say where she dey and as dem com see say, flies dey enter her room like say dem dey do party com make dem contact landlord, wey com break door before dem see say her body don dey rotten on 
June 15.

Dem arrest Spicykvng Vee for Enugu and she dey police hand now.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.