Kano Governor say make viewing centre open sharp sharp
Im make di announce as di chairmo of di soccer viewing association for Kano state visit am for im office on Friday as football don start for Europe so.
Di association as Daily trust yarn di mata tok say make di governor relax di lockdown for di viewing centres dem.
Di governor con donate 40,000 nose masks give dem make dem dey share for di viewing centres. Im also free for di mata wey dem carry come meet am.
For di second time for one week, Naija for thursday don break di record of di highest number of Covid-19 wey bi 681 new case.

Comments
Post a Comment