Kabiru Adjoto do threathen Hope Uzodinma, say make e nor near Edo.
Kabiru Adjoto, wey bi former speaker for Edo State House of Assembly don warn Imo state governor wey bi chairman for di Edo State Election Committee, Senator Hope Uzodinma make e nor near Edo state o.
For inside di yarn wey im yarn give INDEPENDENT on Friday so, Adjoto tok say, Edo pipo nor go allow Uzodinma enter dia state.
"Make Hope Uzodinma hand over to im deputy before im come Edo o. Make im tink di mata well-well before im enter road dey come Edo cos e fit affect im life o. Edo nor bi Imo"
"We go make sure say, Hope Uzodinma nor enta Edo".
"Make im pray wit im wife dem and pikin dem before im go leave Imo. Make im dey ready to chao vulture egg wey dem never cook as im dey enta Edo".

Comments
Post a Comment