Ighalo don tok im mind concerning Man-U mata
Former Super Eagle’s striker, Odion Ighalo don yarn say im no wan go China becos no bi only money bi im focus.
Instead, Ighalo gree extend im loan wey dey Manchester united till next year January after di loan deal wit Shanghai Shenhua bin expire for may 31.
Im yarn dis mata wit Ifeanyi Udeze, wey bi ex international player too untop Brila FM on Thursday morning, Ighalo tok say im reason to stay wit Man-U na becos e bi im dream since im dey for young.
“Sometimes ehn, money nor bi everytin for dis life, to play for Man-U na since I dey for young I don dey reason di mata, no bi say na now I jus reason am”
“I choose Man-U instead make I go back to China and pipo go soon see say na beta tin I do”
“Money good, Money good well well, but I nor fit cos of money, leave my dream”
“Dis mata so ehn, I pray before I make di decision and I know say sometin fit even come dis year as I dey Man-U” Na so di 30 year old striker yarn.
Comments
Post a Comment