Idahosa don run commot for APC join PDP


Chief Charles Idahosa wey bi former commissioner for Information for Edo state don run leave All Progressives Congress (APC), jump enta Peoples Democratic Party (PDP)




Idahosa collect di membership card for im local government for Uhunmwonde Local Government area on Tuesday.



As im dey yarn di mata for telephone interview wit daily independent, one of di member wey dem gather start PDP say, as di man don test di two party, im see say, PDP dey organize and dem dey run democracy well pass APC.

Im still give kudos to di leaders of PDP on how dem take use elder sense settle di kasala wey dey Edo state chapter of di party as dem go enta Thursday primary as one bodi.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.