Ibidunni Ituah-Ighodalo wey bi wife of Pastor Ituah Ighodalo don kpeme



We jus dey hear di sad news say, Ibidunni, wey bi ex beauty queen and wife of owner and Pastor of Trinity Church, Ituah Ighodalo don mud.


She die today wey bi Sunday for inside Port Harcourt as she dey handle Covid-19 isolation mataz. Na heart attach kill am.

As im dey announce di death, Asue Ighodalo yarn on behalf of di family say "Ighodalo and Olaleye Ajayi families dey very sad to announce say dem beloved wife and daughter don die dis morning"





"Una go reason am say dis time no easy for di family sake of wetin happen so and di family go like am make every tin dey low key. All informate about how dem go bury am go dey available soon"

Her Instagram page dey currently inactive. No news about say she die dey her foundation Instagram account.

Di tin wey she post last dey very emotional as she tok e no too easy for her to dey leave her husband even though na she dey travel pass.

Di mama of 2 fine pikin bin celebrate her 13years of marriage for February and dem bin don dey plan her birthday before she mud so.



May her soul rest in peace.



Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.