Ibidun Ighodalo Die: Di family don do Autopsy to know wetin kill am
Family sources tell BBC Pidgin say na on Monday dem conduct di autopsy for Lagos Island hospital.
BBC Pidgin still dey follow up di result of di autopsy and go update di informate later.
Meanwhile, tori don dey comot of di final plans of Ibidunni Ighodalo, di Lagos businesswoman and pastor wey die for Port-Harcourt.
To celebrate her 40th birthday, she write say "I no want party, no surprise" but just to "help 40 couples to born pikin", according to one recent revelation by her friend
Popular musician and photographer TY Bello na di friend wey post wetin di late former beauty queen
Di "help" wey madam Ibidunni Ighodalo dey tok,send am di night - and just hours - before she die.
na her passion to support couples wey wan use In Vitro Fertilization (IVF) born pikin.
'I jus wan make 40 homes happy'
At exactly 11:39pm on Saturday, dis message land di phone of TY Bello - wey tell tori pipo on Monday say na her waka to find pikin make she and Ibidunni become close friends.
No be secret say di wife of Trinity House Pentecostal church founder Pastor Ituah Ighodalo, don try many many times to born pikin with IVF but e no dey successful.
But dis no stop am to help pipo wey wan try IVF, even if e go cost her money and time.
"Di reason why e no happun for some pipo na say dem no fit do [fertility] screening, because some of di tests too cost.
And so I say to myself, make I start [Ibidunni Ighodalo Foundation] to help dem do dis kind of tests," she bin tok for one 2018 interview.
For Nigeria, wey tests to check weda IVF treatment go work for couples dey cost about N400,000 ($1000), and full treatment minus melecine fit pass N5m ($13,000), pesin fit begin reason di kain level of assistance wey di late Pastor Ighodalo ready to give 40 couples in honour of her 40 years birthday.
Di kain heart wey make her decide to adopt two pikin (boy and girl) and become mama to dem, even inside society wia many still see adoption as something to run from.
"Shame no dey inside adoption... I dey happy say I adopt. I get two beautiful pikin," she bin like to tell anyone wey ready to hear her.
Dis gist na from bbc.com


Comments
Post a Comment