I nor dey part of di pipo wey get Execujet o: Dangote




Dangote don talk say na lie o, say im no dey part of di pipo wey get Executive Jets services, di aviation company wey dem suspend im operating license till anytime wey sweet government belle unto say dem no follow wetin government tok as dem carry Naira Marley go Abuja from Lagos to run im concert.

 

As Anthony Chiejina, wey bi Group Head, Branding and Corporate Cummunications for Dangote Group don yarn. Im say Dangote group deny am say Alhaji Aliko Dangote wey bi di Chairman and CEO of Dangote nor get any hand for di Jet company and nor bi dem get di Jet wey dem use (Bombardie Challenger 605 wey di registration numba bi 5N-EXS)

 

Im say dem don see am for online news say Dangote join bodi get di company wey bi private airline wey dey run show insdie Lagos. We deny am reach ground “Dangote nor get anytin wit dem”

 

Even di aircraft, no bi Dangote own. Dangote jus dey keep dem aircrafts inside di hangers wey Executive Jets Services Limited dey run as oda pipo dey do, no bi say na we get am.

 

Make everybody nor follow di fake news wey bin come out before say na Dangote get am.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.