FUOYE STUDENT DIE FOR IM BOYFRIEND HOUSE FOR OSUN POLY




Di lady wey bi 21 year old na student of Federal University of Oye Ekiti (FUOYE) and her name bi Faderera Oloyede. Dem find am say she die for inside hostel of her boyfriend wey bi student too for Osun State Polytechnic, Iree na so VOICEAIRMEDIA yarn di mata.

 

Dem find di dead bodi for inside di boyfriend house for koko area inside Iree wey dey Boripe local government for Osun state

 

VOICEAIRMEDIA hear am say di boyfriend wey im name bi Maliki Ayo bi student of Osun state Polytechnic, Iree.

 

As persin wey im eye dey ground for di mata tok, im say di lady wey die bin come di boyfriend house wit her own friend. Malik now don pick race, dem still dey find am.

 

Osun State Police Comand Public Relations Officer, Opalola Yemisi don tok say, true-true di mata happen as una dey read am so. Dem don carry di dead bodi go Lautech to check for wetin really kill am.

 

Police don begin torch-lighting for di mata.

Dem still yearn say dem don arrest di course mate wey follow her go di boyfriend place. Di coursemate wey her name bi Adekemi Adewumi, say na rice all of dem gather chop for night before dem sleep

 

Police still hol di couse mate as dem still dey run investigation on di mata

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.