Fuel scarcity fit dey o if...
Fuel scarcity fit happen for Naija if oil workers dem carry out dia threat say dem go withdraw dia services for di whole country if government say dem must by force dem to register all dem staff for Integrated Payroll and Personell Information System (IPPIS)
Di petroleum and Natural Gas Senior Staff Association of Nigeria and di Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas Workers don threaten for one letter wey dem write give Minister of State for Petroleum Resources, Timipre Sylva.
The union don disagree wit plan of di Office of di Accountant-General of di federation to register oil workers dem for IPPIS platform.
Di letter wey dem write for June 19, 2020, dey jointly signed by di General Secretaries of PENGASSAN and NUPENG, Lumumgba Okagbawa and Olawale Afolabi.
Di unions dem say, why dem no wan gree for dis IPPIS mata bi say e no consider di differences wey dey oil and gas sector as e take relate wit bargaining agreement and approved pay structure wey dey between di unions and Federal Government.
"We don talk am again say di industrial peace wey dey di sector nor fit dey guaranteed if salary of our members stop or if dem implement am and we nor get hand for inside," Na so di union yarn.
Afolabi confam am say di union go go on strike if di government nor gree listen to dem.
Im don yarn say dem never choose date wen dem go strike becos dem believe say government go listen to dem.
Di letter still tok say di unions dey surprise say even though e never tey wen di Federal Government revive di Government Integrated Financial Management Information System, wia all di affected agencies dey on now. The office of di Accountant-General of di Federation still insist say dem wan by force oil workers for IPPIS platform.
Im describe di IPPIS platform as somtin wey no balance well and get too many wahala. The unions dem say make di petroleum minister chuk mout for di mata make e for nor cause wahala for di oil sector.
Im describe di IPPIS platform as somtin wey no balance well and get too many wahala. The unions dem say make di petroleum minister chuk mout for di mata make e for nor cause wahala for di oil sector.
Di two unions don yarn say dem still dey wait for Sylva's make e chuk mouth for di mata.
Comments
Post a Comment