Dubai police don release how dem take arrest Husouppi and im gang




Di Dubai Police Force wey dey United Arab Emirates, don expose how dem take arrest Nigerian Instagram Celebrity wey Im name bi Ramon Abass Igbalode, aka Hushpuppi.

For di video wey dem release on dia official Twitter handle for on Thursday, di police wey dey Middle-East tok say dia special team don dey track di suspect and Im gang for all di activities wey dem dey do for social  media for four months.

Di Police expose am say as dem arrest Hushpuppi wit 12 member of Im gang, dem discover say fraud of 1.6 billion Dirham (N168 billion) na im dem fraud different pipo.


Na pipo wey reach 1,926,400 from different part of dis world don fall for dem wayo.


As Police tok am, dem see 13 big moto wey dia moni enta 35 million Dirham (N3.7 billion) collect from dem wen dem arrest all of dem.

Di Dubai Police say di name of di operation wey dem take arrest dem na "Fox Hunt 2"

As dem dey play di video, di narrator wey dey tok for di video say "for less dan four months, Di Dubai police force fit finish di operation wey dem call Fox Hunt 2, wia dem arrest 12 gang member ontop di mata. 

"Dem raid six places for same time as di suspects dey dia houses for Dubai dey sleep. After dem don spend months to investigate and touchlight di mata and to monitor dia social media account, team of police wey get ogbonge training get dia location and activities."

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.