Dem go bury Ajimobi tommorrow
Confam sources wey close to di family don yarn say dem go bury di former Governor by 10:00am tomorrow wey bi Friday as e bi for Islam.
Di man wey bi 70 years wen e die bin don dey life support since last week Friday for First Cardiology Hospital for Lagos after im enta coma unto say di corona virus wey dem im body complicate, finally die on Thursday, 25th June, 2020.
Ajimobi wey bi Governor from 2011 - 2019. Dem bin name am as di acting Chairman of APC but di guy die before im go resume.
Im bi former Chief Executive officer for National oil and Chemical Marketing Company wey bi part of Shell Nigeria. Im die unto say im bin get sickness for bodi wey corona virus con complicate.

Comments
Post a Comment