Dem don postpone Ajimobi burial

Dem don postpone di burial of di former
Governor of Oyo state, Senator Abiola Ajimobi. 





Im spokesman, wey bi Bolaji Tunji tok am for Im Oluyole Ibadan house on Friday morning say di family go soon announce wen di burial go bi.


Tunji tok say "Di burial arrangement go dey announced by di family soon and na coded mata e go bi make e for follow Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) dem guidelines.

Im still beg pipo wey dey join dem feel di pain, wey don dey enta di man house since Im die make dem follow NCDC guideline, make dem dey wash dia hands, use face mask and make dem nor too dey near each oda.

Ajimobi die for private hospital for Lagos on Thursday for 70years old.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.