Dem don kill di Father-in-Law of di APC Governorship candidate wey dem disqualify for Edo state
Prof. Christopher Ogieghor, wey bi papa of di wife if di APC governorship candidate wey dem remove, wey Im name bi Matthew Iduoriyekemwen, don enter bad pipo hand as dem kill am witout mercy.
Ogiehor, wey bi 80 years and im bi surgeon, and im still bi di Medical Director of City Clinic dey for im house for inside GRA for Benin wen dem go kill am.
Dem meet di man say e don die for early momo on thursday. Di killers dem break im head and still tie im hand join.
Edo Police Publc Relations Officer (PPRO), Chidi Nwabuzor wey im rank bi Deputy Superintendent of Police (DSP), don tok say true-true, dem kill di man. Im confam di mata on top phone as police sef don bigin investigate on di mata.

Comments
Post a Comment