Dem don kill BBNaija star, Khafi brother for inside London
As di Sun UK yarn di mata, dem shoot di guy wey bi 20 year old student close to im family house for place wey dem dey call Shepherd Bush for inside west London.
Di guy bin dey scream "helep me" as im dey ground dey die for around 12:40am.
Pipo wey dey pass try to give am wetin oyinbo man dey call CPR before ambulance enta di place wey di mata happen. But di guy wey im name bi Alexander die small time after.
Test wey dem carry out on di dead bodi show say na gun kill am
Pipo dey drop fine fine flowers near di place wey di evil happen yesterday wit brandy join wit cross. Dem still drop message, and picture wey Im with Im classmates dey inside wit message wey say "you go always dey inside our hearts"
Cry full ground remain...
Police don dey ask for any informate about di white Range Rover wey di killer carry wey dem lata see say dem don burn am for place wey nor to far from Ealing.
Police oga for di case say dem go do every tin to make sure say di pipo wey cause dis unnecessary and bad gbege come go face di music.
Comments
Post a Comment