Dem don bury Cynthia Obieshi wey die after she go nak man for imo

 


Cynthia Obieshi wey bi student for Federal Polytechnic, Nekede, Owerri, for Imo state wey die after she and her boyfriend wey bi Samuel Osuji nak each oda don enter ground on Thursday, Na so PUNCH yarn di mata.


Dem bury di lady wey bi 25 years old as cry dey join cry for inside her papa house for Umuaro community inside Mbano Local Government for di state so.

PUNCH bin don yarn say di two of dem wey bi students die on sunday for inside hotel wia dem meet to do di do.

Police spokesperson don report say dem meet am say di two of dem don die inside hotel after dem do do wetin dem wan do finish.

Police hear am say Cynthia bin go visit her boyfriend wey dem gather die so for June 13 and dem sleep for one hotel but dem no gree wake up again.

Police still dey touch-light di mata but from wetin dey don see for now, bi like say na drugs wey dem use kpeme dem so.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.