Browny Igbeogwu and im wife, Becky don born pikin after 10 years of marriage.



As dem share dia mata, Di Nollywood actor write say:

 

Na 10 years e take for dis tin to happen. Who fit fight God, I say NOBODY. I nor know about you o. Wia dem dey, di witches and wizards dem.

 



"Go marry anoda wife, time nor dey, age nor dey her side again, find small girl make you give am belle. Brown you dey try o but how long you go wait? Oya, adopt baby first as you dey wait. All these Asaba girls, who know wetin she do dey come dey affect her nownahe nor for born. Na to buy new car? Make im born first im go understand. Your children go don reach four now o".



Na all did tins my ear hear and e make me feel bad but I keep quiet as dem dey laugh me. I carry my mata meet Baba God for prayer and today, me and my wife get reason to thank God.


Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.