ASUU warn dia lecturers make dem no try am





Dem ogas for Academic Staff Union of Universities (ASUU) don say make lecturers for di whole country nor try to teach students for online o.

As lockdown dey unto di corona virus mata wey we still dey chew for mouth so, many universities don dey reason to go online as di Minister of Education say make dem start online teaching for April.

For inside one memo, ASUU presido, Prof. Biodun Ogunyemi tell dem lecturers make dem nor try am cos if Senate no put hand, Vice chancellor nor get power to change how lecture  bi.

"As di mata bi now, make una no listen if any Vice Chancellor say make una con dey do online teaching. Dem fit try use scope for una. Di law of our universities no allow dat kain tin. Na our universities we dey fight for, make all di students and di whole Naija pipo no gree for government".

Di president don warn all small small chairpersons dem join wit exco members dem make dem nor listen or even go for meeting for mata wey affect di union if dem no collect clearance from dia zonal coordinators. Im still tok say for state university, make dem no meet wit any visitor except dem collect permission from National Strike Coordinator Committee (NSCC) thru ASUU president.

Im say, no matter wetin happen, ASUU members and dem families don make up dem mind say "Did one na to show dia commitment to di struggle wey di union dey struggle to take save di education system for Naija"

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.