ARMED ROBBER ENTER POS SHOP LIKE COMMANDO
Four pipo don collect shooting from armed robbers as dey rob one POS shop for inside Panyam District, for Mangu Local Government inside Plateau State.
Di mata happen for night around 9pm go reach 9:30pm for on sunday, June 14. Na dis mata make pipo for Panyam dey fear and shake o.
One man wey im eye see di mata as e dey happen, Dakok, say di armed robbers dem enta di place like commando film as dey start to dey shoot for up make pipo for clear before dem enta di POS shop wey di owner bi Ifeanyi Ide.
"As dem enta di shop, we hear gun dey scatter, na so we reason say dem don kill di POS man o.

"Na after dem commot we com see am say notin do di POS man, but four customers wey dey dia share inside di bullet wey dem spray," Na so Dakok yarn.
Di DPO of Mangu, Mr Yusuf Balami, don tok say, true true, di mata happen. "Di armed robbers enter di POS shop and dem carry money wey we never know di amount, dem still wound four pipo wit gun join"
Im say, as dem receive call say robbery dey happen, na so im mobilize im officers make dem enta Panyam, but before "we reach di place, dem don rob comot".
Im still tok say di pipo wey gun meet so dey hospital dey collect treatment for COCIN Rural Health Hospital for Panyam.

Im say as e bi now, dem neva arrest anybody, but dem dey try to track robbers to make sure say dem face di law.
Comments
Post a Comment