Woman for Lagos soak her pikin for water till di pikin die
My pipo, tins dey happen for dis life so, as dis woman use her hand take kill her own pikin.
Di mata happen for Gowon estate for inside Lagos wia di woman say she bin don dey tink of how to kill di pikin as na di pikin no make her enter Law school so. She say na di frustrate of say money no dey join wit say di pikin don bring shame and embarrassment to her.
She bin don reason different style to kill di 22months old pikin like to use pillow choke am and so on but na wen her sista warn am say she dream bad dream about water, make she dey carry di pikin far form wia water dey. Na dat one make her reason say, water go sweet to kill dis pikin.
Di day di mata happen, she say di pikin dey EPP her dress up cos e dey tink say dem wan gather commot but she con clear di pikin say, na here you go die and na she go kill am after, she go carry her body to police. Last last, na so she do am, she put water inside drum, put di pikin inside, she nor gree die, second time, she put more water, di pikin still nor die, na him she turn di pikin upside down inside di long baff wey water dey, till di pikin kpafuka.
As she do am finish, she write letter give her sista say as she don dey talk say she go kill dis pikin o, she don finally do am, and after, she carry herself go report for police say she no feel bad for wetin she do at all.

Comments
Post a Comment