WHY CANADA GOVERNMENT NOR ALLOW AIR PEACE CON CARRY NAIJA PIPO COMMOT DIA COUNTRY
Di government of Canada nor allow air peace wey bi Nigerian local airline carry Naija pipo wey dey Ottawa unto say air peace nor get right to run show for dem country,
Mr Onyeama, wey be di oga of air peace don say no bi lie at all, say na so di matter really bi.
E con still tok say him believe say di Canada government go change dia mind ontop di mata.
E make us know say Nigeria Ambassador wey dey Canada don start to reason di government of Canada make dem think di matter again.
Dis mata wey dey ground so na serious mata unto say no bi say Air peace wan dey run airline show for Canada, say di situation na State of Emergency package and di two dey different.
E conclude di mata say e believe say beta go stil happen.

Comments
Post a Comment