Tiwa Savage say she fit naked for her next music video




Tiwa savage wey release 49-99 song time wey never too tey don yarn say she dey very hapi as di song hit well well so. She say every body wey dey di music video, plus join di directors dem na Naija pipo and she hapi say as she present am to her music label, dem accept am cos na wetin we fit do as Africans.

Tiwa, wey dey work on new project now wey she call, Celia, say she fit open full yansh make people for see wella as she nor know wetin she fit do again to make di video sweet pass wetin don dey ground before.

Tiwa wey dey around 40years old still yearn say as dis corona mata dey go so, e fit bi say na her iPhone she go use take run di music video o.

She make us understand say her new project, Celia, na about di African woman, wetin African woman dey go through, how she dey form boss, and oda tons like DAT.

Her mind dey wit pipo for did kain period cos nor bi everybody go fit buy food for house.

We go remember say na last year she commot for Don Jazzy record to join America Universal Music wey pipo like Rihanna and Lady gaga dey.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.