Police don free E-Money after dem question am




Chairmo for 5-star music Emeka Okonkwo aka E-money, enter police hand today.


E enter our ear say today, the oga patata of Police nor too happy with how E-money dey live him life.


Dem say, e too dey do and e dey use police like say e dey use boy boy. Na unto dis matters dem make di oga patapata of police say make dem ask di guy some kain matter.


E-money enter Nigeria Police Headquarters annex for Obalande, for Ikoyi DAT kain one O'clock for afternoon, we hear say di guy kak up with wine suit enter the zone.


Wen e land, dem bin question am for 6 hours and after dem gree release make e go rest small, come back on Wednesday.




Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.