POLICE BEAT LASTMA TILL E FAINT
E enter our ear say some police don beat one oga for LASTMA, Ronald Fuludu, till di guy faint. Di mata wey tie wrapper, wear helmet join, happen for Apapa for inside Lagos.
We hear am say di reason dem beat di guy na say, e dey chuk mouth for police mata wey no concern am. Na one police SP, Femi Iwasokun lead him other policemen dem to run di show.
E happen say LASTMA pipo don dem dey control traffic for eleganza area, for apapa before police people show and wen dem show, dem con take over di traffic mata. Fuludu yarn say, di police SP con meet am make dem agree dey collect money for motor wey dey pass but e nor gree with am. Later, police con block di normal way wey motor dey pass, dem con also open road wey still dey under construction.
When e con go challenge dem, na so one of dem oga, come land am hot slap and di other one hit am with stick before di guy finally faint. Police collect phone from LASTMA officer wey try to record di mata for phone.
LASTMA Public Relations Officer confirm say as we hear di mata, na so e bi, as dem dey ask am more question, di guy lock up.

Comments
Post a Comment