NAIJA ARMY KILL 9 BOKO HARAM MEMBER DEM
Army pipo wey dey sector 1, operation Lafiya Dole, don kill 9 Boko Haram wahala pipo dem as dem set ambush wey dem use talk capture dem along Mainok-Jakana road for Kaga Local Government for inside Borno state.
Army report say di waylaying wey happen around 6pm for Wednesday evening lead to as di Boko Haram and Army dey shoot dem self. 2 soldiers don injure for di mata so.
Dem don also collect 2 truck wey get gun full inside. Everytin don cool down small for di area.
Comments
Post a Comment