Jeff Bezos fit bi Trillionaire by 2026
As countries dey shake cos of coronavirus, Jeff Bezos fit no get any stain for him body after. E fit even bi di first human being wey go bi Trillionaire as research make us know.
Jeff Bezos wey start Amazon don increase him money from $125billion to $143billion as Blomberg Billionaire's index talk. Di mata full twitter say as e bi so, di man fit be Trillionaire by 2026.
Di man business make $75billion for di first 3months for 2020 as demand for tins online increase cos of corona mata
If dis guy enter Trillionaire level, e go get money pass 179 countries and pipo wey pass like 3.4billion. Di guy money still dey grow even as him wife collect plenty inside cos of divorce.
If dis guy enter Trillionaire level, e go get money pass 179 countries and pipo wey pass like 3.4billion. Di guy money still dey grow even as him wife collect plenty inside cos of divorce.
Comments
Post a Comment