FG TOK SAY MAMBILA LIGHT PROJECT NOR DEY WETIN DEM WAN USE ABACHA LOOT WEY DEM RECEIVE DO



Di Federal Government of Nigeria reverse wetin dem tok before say di money wey dem just collect from money wey Abacha steal. Dem yarn say Mambila power project nor dey wetin dem wan use di money do o.

As di senior special assistance for media matter, Garba Shehu don yarn say di money na only for Lagos-Ibadan expressway, 2nd Niger bridge and Abuja-Kano road alone. though mambila power project dey part of di important project for dem list, but e nor dey di agreement wey dem sign wit United states and British territory of Jersey government dem.

E still tok say, him bin yarn before say di power project dey among but na honest mistake, make di public no vex and make everybody use dis one take know how di matter bi now. 

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.