Ebonyi state wan borrow $US80million for road construction




Ministry of Finance, Budget and National Planning, don present letter wey Ebonyi state government write say dem wan borrow US$80million from di Islamic development Bank for the Federal Executive council meeting.

Di minister of di ministry, Zainab Ahmed tok am as e dey follow news pipo yarn for online meeting of di federal excutive council on Wednesday, wey presido Muhamadu Buhari bi chairaman for.

Di ministry yearn di matter on behalf of Ebonyi state government, wey dem wan use to construct Abakalilki ring road wey connect di 13 local government areas wey dey di state.

Na Federal government dey borrow dis money on behalf of Ebonyi state and she say dem don reason and check di matter say Ebonyi get di liver to pay di moni back.

Di ring road go make sense as e go connect 13 local governments for di state plus join Cameroon republic wey nor too far from dia.


Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.