COVID-19: LAGOS STATE GOVERNMENT SAY MAKE PIPO VOTE IF DEM WANT LOCKDOWN OR NOT
Di Lagos state government dey reason to lockdown di state again as di case for corona dey grow and as Lagos pipo nor gree follow as government say make dem give each oda space.
Di Government reason pipo for twitter if dem wan make di government lock di state again or not. As pipo vote finish, e con happen say around 12pm on Wednesday, over 53,000 pipo don vote, 51.4 percent say make di government lock am again, 37.2 percent say make dem nor lock am. The 11.5 percent wey remain Sidon for middle fence.
Government for di state bin vex say dem wan lock di state unto as dem see am for video and puctures of how pipo for dia nor send anybody as e relate to COVID-19. Crowd always full entrance for bank wey dey struggle to enter, and dem no gree give each oda space, na same tin dey happen for bus stop wen pipo dey try enter buses dem.
Many pipo for twitter don say government nor try as dem put did kain sensitive mata for vote. others tok say many pipo wey di lockdown dey really affect nor dey twitter.
Di Executive Director, African Partnership, Tunde Arogunmati, tweet say for government to lockdown state, dem must fit beat dem chest say dem go provide food and security for dem pipo. Lockdown fit only work well if food and beta security dey for pipo.

Comments
Post a Comment