Atiku don yarn say make government sell presidential jet and cancel renovation of National assembly
Vice president before before yarn say as government dey do with 2020 budget, dem dey form like say dem no know how everything bi this time.
E say, instead make den review budget, government suppose sell eight or nine from di jets of di presido, make dem also cancel renovation of national assembly.
As price of oil don fall worldwide, e dey pain am say government nor fit increase how money dey enter dem purse.
E advise say make government cut coat according to size, make dem put naija pipo first.
Any budget wey nor reduce pass 25% no go benefit naija people and nor bi only to reduce am but make dem re run di budget make dem nor use money dey run multiple arms wey nor get meaning, instead, make dem invest more for education, infrastructure and more important one be health.

Comments
Post a Comment