ARMY pipo kill civilian wey him name bi Rinji Peter Bala.

ARMY OFFICE WRITE COMMOT FROM DEM SAFE HAVEN OPERATION SITE AS E CONCERN HOW DI BOY TAKE DIE





Dem say na around dat kain 10pm on May, 12, 2020, informate enter dem ear say some suspect armed robbers and cult boys dey worry for 18th street, Jos south LGA for Plateau State. Di informate show say di bad boys dem dey use di opportunity of as everwhere lock so take dey scatter town. As e don bi like dat, Army pipo from sector 1 patrol troops of OPSH sharply enta di area and dem nab 7 pipo wey dem suspect and dem carry dem go dem office for touch lighting.

Afta dem don touch light dem wit plenti question dem allow 5 of dem commot dey go free, but e com happen say as dem dey commot so, one of di officer wey dey duty con tink say dem bi suspect wey wan escape. Na so e rush dem wit bullet wey con lead to as Mr Rinji Bala Peter take mud.

As e bi now, investigate dey go on to know wetin cause di officer to do dat kain tin. Dem also talk say dem don arrest d officer wey dey involved for di mata.

Dem condemn di accident say e nor good at all and dem con send dem pipo make e go greet di family of di boy wey die. OPSH don announce say make everybody cool down, say di truth go come out and di boy no go die for notin

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.