ANAMBRA DON NAB TRUCK WEY WAN CARRY PIPO JOIN ANIMALS ENTER ONITSHA
Igbere TV don announce say one lorry wey I'm registration number bi MGR 148 XA wey carry pipo wey reach thirty three from Plateau state don enter yawa in front og government house, Awka as dem dey try enter Anambra state and security agencies don return dem go Anambra/Enugu boundary
Dem load with goat, motocycle and some oda tins. After dem question di pipo wey dey inside di moto, dem confess say na from jos dem dey come from to come do business for Onitsha.
Di Chief Press Secretary of Goveror Obiano, Mr James Eze don yarn say even though dem bi Naija pipo, dem no follow government order dey no allow movement from one state go anoda one wey Presido Buhari command.
E say make every state follow di order make we take quickly pursue Covid-19 comot for we country.



Comments
Post a Comment