6 tins wey show say your bodi need plenti water



Our bodi as man pikin need plenti water cos we dey lose water steady. Di level of water wey we dey lose depend on tins like activity and weather.

But Di good tin bi say bodi go always tell us say e don need water. Di one wey easy pass na say water go hungry person. Notin fit replace water as e bi so as we need a for beta health.

Some of di way wey bodi dey tell us say e need water na;

1. Hunger even if e bi say we jus chop finish
2. Joint pain
3. Dul or dry skin or wrinkles
4. Piss to tey before e come
5. Piss go get color
6. Person go taya and mood swing.

Color of piss dey very important as normal piss suppose light. If your piss dey dark, e mean say u dey overwork your organs  as enough water no dey for dem to work well. 

Normal person suppose piss six to eight times a day and sweet drinks no fit replace water for bodi.

Di amount of water wey you depend on your bodi and individual condition



Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.