33 years old Corona virus patient don born for Gbagada Covid-19 care centre.
Commissioner for health for Lagos State.
#Covid19 Update
Tok say on di behalf of di overall oga for di state wey bi di governor, Babajide Sanwoolu, him dey hapi to make us know say baby boy wey weigh 2.9kg don show for di isolation centre for Gbagada. Say na di @LSMOH pipo dem run di show.
Dem do operation wey successful for di mama of di pikin wey be 33-years old, and as e dey yarn now, both mama and pikin dey very alright.
E say dem dey monitor dem properly as e suppose bi and e greet health workers dem specially for di beta work wey dem dey do for dis kain time so.
If we join hands, na small tin to pursue covid 19 comot.
#ForGreaterLagos



To God be the glory
ReplyDelete