3 fulani herdsmen and 9 cows don die for hands of unknown gunmen
Some gunmen wey dem never know don kill three Fulani heardsmen and nine cows for Egume, Deina local government for inside Kogi State.
Di chaimo of Miyetti Allah cattle breeders association, MACB, na im took am for Sunday for Lokoja .
Di secretary wey took on behalf of di organization,Mallam Ademu Abubakar tok say plenti times, dem don experience dis kain tin wey gunmen go jus come kill heardsmen and cows.
Many pipo injure for di mata wey happen for some minutes. Dem jus dey shoot enter our camp wen nobody provoke dem, di pipo wey den kill na Tame Idris, Fatu Idris and Abdulkareem Saleh

Comments
Post a Comment