#100M Bribe: EFCC nab two Chinko men wey wan bribe dem oga for Sokoto




EFCC dey vex as e dey so o, as two Chinko men bin wan use N100M bribe dem make dem for nor see road.

Dem zonal office for Sokoto don nab the two Chinko wen their names be Mr. Meng Wei Kun and Mr Xu Koi, as dem try kolobi the oga for that region, Abdullahi Lawal with 50 million naira CASH.

Na Monday, 11th May, na hin EFCC nab them.

Di zonal office bin dey touch light the construction company wen government give work to arrange beta road for Gummi Bukkyum, Anka, and Nassarawa for Zamfara state; make dem also arrange one hundred and sixty eight (168) solar borehole for 14 local government for di state.

As d company see say e bi like say EFCC wan dey touch light dem, dem con reason Oga Lawal N100,000,000 (One hundred Million naira) as "shut up your mouth" make the mata for die

Dem nor know say Lawal sharp pass dem, Lawal wety bi beta Naija man enter di film like say e wan collect di money, na so di company send these two men make dem con drop Fifty Million Naira (50,000,000) from d moni as half payment.


See money for ground.






Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.